Friday 14 September 2012

Naija Dey Dishonour Honour


Every where,
Even before before for Naija
Dem dey take honour
Tell country people
Wey do better thing dem
Well done.

Person do better sport
Dem go take honour
Tell am well done.
Person write better write write
Dem go take honour
Tell am well done.
Person play better politics
Dem go take honour
Tell am well done.
Person do better business
Na honour dem go take
Tell am well done.
Better every every
Dem go take honour say
Well done.

Now di moto don enter reverse,
Now
Naija dey dishonour honour.
Today dem go catch country person
Wey dey thief Naija money,
Tomorrow dem go carry am go court.
Next tomorrow
Court go give am bail,
Case file go waka,
Case go finish.

Next year
Di country person
Go show for honour,
Naija dey dishonour honour.

No comments:

Post a Comment