Friday 14 September 2012

Na Me And Asiwaju Obama Invite


Naija write write people sef,
Dem no dey rest,
Busy body full dem body.
Even sef
Bad belle full dem belle.
Na so dem dey busy busy,
Dey put put eye,
Dey put put mouth
For di thing wey no concern dem.

Dat small invite
Wey our friend
Wey be Presido Obama
Invite me and Asiwaju
Wey carry we go yonder,
Wey carry we go
For Obama party nominate,
Busy body don enter,
Bad belle don enter.

Dem don dey talk say;
No be Obama invite Asiwaju.
Dem don dey talk say;
Na Asiwaju go by im sef,
Which kin yan be dat?

All na lie lie,
Na me and Asiwaju Obama invite,
Me na Naija leader of position.
Asiwaju na Naija leader of opposition,
Na me and Asiwaju Obama invite.

No comments:

Post a Comment